APC 100million form: Nigeria ruling party put N100m price for presidential form – BBC

Wia dis foto come from, Presidency
Nigeria ruling APC say those wey dey eye dia presidential ticket gatz hold 100 million for pocket.
Na money wey pesin fit use build at least three houses inside modern day Nigeria na im APC set as fee to buy presidential form for 2023 election primaries.
Nigeria ruling All Progressives Congress [APC] National Executive Committee [NEC] set di 100,000,000 naira fee on Tuesday afta dia meeting.
Di cost dey unlike di main opposition Peoples Democratic party [PDP] wey dey sell dia presidential form for N40 million naira.
E cause reaction among many Nigerians wey feel say di price too cost and e also make election dey expensive.
However dis same presidential expression of interest and nomination form na free for women and pipo wit disabilities. While youths gatz pay half di price.
APC NEC meeting hold for Abuja and na president Muhammadu Buhari chair di gathering.
Di highest decision making organ of Nigeria ruling party reach agreement on different issues especially as e concern di 2023 general elections.
Part of di outcome of di meeting na di time table for di activities wey go lead to di "special convention of di party".
Then dem discuss di price of interest and nomination forms for all elective positions for di elections.
Di APC say dem go begin sell nomination and expression of interest forms for various elective offices from Saturday April 23, 2022.
Dis na according to document wey Sulaiman Arugungu, di National organizing secretary of di bring out.
"In accordance wit di provision of di Electoral Act and di timetable of di Independent national electoral commission (Inec) APC hereby release timetable.
"And schedule of activities for di conduct of di 2023 general elections," Argungu tok.
APC say di primary election for governorship position go hold on 18 May, 2022.
While state houses of assembly go hold on 20 May, 2022.
Di ruling party house of representatives primary go hold for 22 May and 24 May for Senate primary.
Di party go end di process on 30 May wen dem go hold convention for presidential primaries.
Wia dis foto come from, APC
"Forms for female aspirants and pipo wey dey live wit disability na free." APC add.
"Youth wey dey age 25 – 40 years get 50% discount to buy di nomination forms," Argungu tok.
Wia dis foto come from, Presidency
Di Nec meeting na di first wey di APC di hold afta dia National Convention wey dom hold for 26 March.
Di Nec meeting na di first wey di APC hold afta Abdulahi Adamu become national chairman.
APC bin elect new party executives from dia National Convention wey dem hold for 26 March.
Di meeting last up to four hours and leaders of di party attend di meeting.
Vice President Yemi Osinbajo, Senate President Ahmad Lawan, Speaker Femi Gbajabiamila, di party national chairman, Abdullahi Adamu dey among di leaders wey attend meeting.
Some of di oda decision wey di party reach for di meeting na;
Di new Electoral act for Nigeria wey president Muhammadu Buhari recently sign give political parties three ways to select dia candidates for any election.
Dem be direct primary, indirect primary or consensus candidate.
Ahead of di 2023 general elections di ruling APC choose to use di indirect primaries.
Di Indirect primaries na use of delegates to select candidate for election. Wetin dis one mean be say na only delegates from each state go vote who go be APC presidential candidate.
Bola Tinubu, Yemi Osinbajo, Orji Uzor Kalu, Rotimi Amaechi and Yahaya Bello don already indicate interest to contest di presidential election under APC.
Odas na Dave Umahi, Rochas Okorocha, Ken Nnamani and Chris Ngige don also announce dia interest.
© 2022 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

source

Leave a Comment